Fest langwej | Yoruba Langwej ![]() |
---|---|
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | Yoruba Langwej, English langwej, French, Brazilian Portuguese, Spanish ![]() |
Rilijon | Christianity, Islam, Yoruba religion ![]() |
Kontri | Benin, Naija, Togo, Gana, Canada ![]() |
Language used | Yoruba Langwej ![]() |
Studied in | Yoruba studies ![]() |
Yoruba pipul na one West Afrika grup of pipul dat stey in Naijá, Benin an Togo. Di nem of di aria wey Yoruba pipul dey stey na "Yorubaland".Di nomba of Yoruba pipul for Afrika pass 48 million. Outside Afrika, Yoruba pipul pass som hundred thousand.Na Naijá you fit see mejoriti of Yoruba pipul. In Naijá populashion, Yoruba pipul mek up to 21 paset akordin to CIA kalkulashion.Yoruba pipul dey amog one of di traib wey meni pass for Afrika.Na almost all yoruba pipul dey spik di Yoruba langwej. For Afrika, Yoruba pipul get bandiri wit Itsekiri to di Saut-East in di North-West of Niger Delta.Yoruba pipul get bandiri with Bariba to di North-West in Benin an Naijá.Dey also get bandiri wit Nupe to di North an get bandiri wit di Ebira to di North-East in sentral Naijá.For di east, Yoruba pipul get bandiri wit Edo, Esan an di Afemai grup in mid-westa Naijá.To di Southwest, Yoruba pupil get bandiri wit "Gbe" spikin pupil , Mahi, Gun, Fon, an Ewe who dey Benin an Togo.